Jokes for souls

My android phone don chop my money tire, na him I come vex yesterday sell am, come take some money buy Chinaphone! The phone get TV, Touch screen, Nail cutter, Fire lighter etc. I fit write Text message with toothpicks sef. But now am in bigger trouble!!!
1. E go full after 3 minutes of charging.
2. The spellings get mistakes e.g NokLa, blackderry, i-pon, samswag etc.
3. When aeroplane pass, e go record "One missed Call".
4. When a big car horn; e go show "Charger connected"
5. When Chinese man pass, e go show: "One Bluetooth device found"
6. When fine lady waka pass, e go show "WiFi On"
7. When ugly lady waka pass, e go show, "Virus detected"
Abeg ooo! I wan sell am! Who wan buy ooo? Even as I dey find buyer, e dey show me for screen say "No contacts found"
Pls don't laugh alone, share with those you wish to put a smile on their face......

Comments

Popular posts from this blog

Lagos strip clubs returns to Business

Inside The Ibadan ritual camp

After Nnamdi Kanu's release, PDP makes huge demand from Buhari